Popular Nigerian TikToker, Jadrolita, don reply her close friend, Peller, after e talk say e wan marry her because of how e stand gidigba for her during her jawline surgery recovery.
Jadrolita, wey people sabi for her AI-themed content before she start dey do collabo with Peller, recently do surgery to remove tumor for her jaw, and she still dey recover for hospital. Since she enter hospital, Peller no leave her side, as e dey show full support wey even make fans dey hail am.
For one video wey dem post, Peller dey playfully talk say him go marry Jadrolita, as e remind her say na only him dey take care of her since. E still joke say she no fit ever call am illiterate again after all the things wey e don do for her.
For the comment section of the video, Jadrolita thank Peller well-well for everything wey e don do for her, but she make am clear say she no fit promise marriage. She even yarn am say him reward dey for heaven.
She write:
“Your rewards is always in heaven there is nothing in this world .”
But Peller no gree happy with the talk, as e reply:
“One person come dey say my rewards dey heaven. God forbid watin do earth”
Check the screenshot below:
See how people dey react to Jadrolita’s comment below